National

Police Arrest 29-Year-Old Ondo Man, Say Im Hide Human Bones For House

todayApril 24, 2026 2

Background
share close

By: Esther Ayoola

Police for Ondo State police command don do Rambo arrest one 29-year-old man, Awomehinde Tope, for Ile-Oluji area after allegation say im go thief im papa property.

Police tuk, tuk person, Abayomi Jimoh, naim dey convasate dis mata  say di reason for di arrest be say, di suspect allegedly carry away tins like motorcycles, goats, palm oil, phones, gas cylinders, gold items and rugs from im father.

Jimoh sti explain say as police dey investigate, dem discover say one of di rugs im don already sell am to another person.

Na during di search for Ile-Oluji, dem find some items wey dem suspect say be human bones, say like di police investigation sti dey go on.

Written by: News Author

Rate it

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app