By: Esther Ayoola
Di Assistant Inspector General of Police (AIG) for Zone 2, Olohundare Jimoh, don burst one secret warehouse for Mende area of Maryland, Lagos, wia dem recover 425 bags of Canadian Loud and other drug items.
Jimoh fry mouth say Police do dis special operation for No. 10 Olori Adekemi Ajibola Street, inside Mende over di weekend.
Dem target one 41-year-old man wey name na Henry Ifeanyi, dat im bin dey use three-bedroom flat run di dirty deals.