By: Esther Ayoola
Kwara State Police Command show workings confamate say dem don receive and later release six vigilante members wey Nigerian Army arrest earlier for Edo State.
Police tuk say soldiers stop di vigilantes for Auchi–Ikpeshi Road for Akoko-Edo LGA for early December 2025 as dem dey travel inside motor wey belong to Ifelodun Local Government for Kwara State.
According to police statement wey come out on Tuesday 6th Jan, 2026, di Army hand over di six men to Kwara Police Command on Wednesday, December 31, 2025.
Police say Brigade Commander of 22 Armoured Brigade for Sobi Barracks, Ilorin, Brigadier General N. N. Rume, formally hand over di vigilantes for investigation and profiling before dem release dem.