Entertainment

Police Don Rescue Peller From Alleged Kidnappers

todayAugust 28, 2025 205

Background
share close

Nigeria police force don rescue popular TikToker, Peller, wey dem kidnap. Peller, wey plenty people sabi for TikTok, some unknown gunmen kidnap am on Wednesday while e dey do live video for social media.
But for new update wey show for social media on Thursday morning, Peller close padi and colleague, Sandra Benede talk say police don rescue am. For live video, Sandra talk say dem don find Peller and now e dey with the DPO (Divisional Police Officer).
“Dem don see am. DPO don see am. Dem no give full details but dem don see am”, Sandra talk. People wey dey follow this matter dey happy say Peller don safe after the wahala wey happen. Police still dey investigate to catch the kidnappers.

Written by: Rilwan Agbomeji

Rate it

Similar posts

Entertainment

Must Read: 2Baba and Annie Break Up Story

By: Kofoworola Olayinka   Sometimes, love fit real, di memories fit sweet, di children fit precious, but somehow, di marriage still fit scatter for ground. Check 2Baba and Annie Idibia tori from start to finish, you go understand wetin we dey yarn for here and why dia breakup pain plenty […]

todayAugust 31, 2026 7


WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds