Listeners:
Top listeners:
play_arrow
KonfamFM 89.5 We Dey For You
By: Esther Ayoola
Di Lagos state police command don go arrest one couple wey call demselves Fred and Goodness afta dem stage dia own kidnap to collect N10 million ransom from family and friends.
According to Police source, say dem fake di kidnap for January 7 because di man wan travel back to US and as money no dey, so dem make di plan together.
Say, na for one school area for Mushin, police go catch dem as dem dey collect di ransom, afta officers notice some kukere waka for di mata.
Konfaming di mata, Lagos Police tuk, tuk, Abimbola Addebisi, say, true, true, na self-kidnap be di case and di couple go soon face court afta investigation finish.
Written by: News Author
Couple Arrested Lagos Crime News Nigeria FAKE KIDNAP SCAM LAGOS POLICE
We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.
We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!
Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!
Copyright KONFAM 2025