Lagos

Police Nab Lagos Couple Wey Fake Kidnap

todayJanuary 30, 2026 15

Background
share close

By: Esther Ayoola

Di Lagos state police command don go arrest one couple wey call demselves Fred and Goodness afta dem stage dia own kidnap to collect N10 million ransom from family and friends.

According to Police source, say dem fake di kidnap for January 7 because di man wan travel  back to US and  as money no dey, so dem make di plan together.

Say, na for one school area for Mushin, police go catch dem as dem dey collect di ransom, afta officers notice some kukere waka for di mata.

Konfaming  di mata, Lagos Police tuk, tuk, Abimbola Addebisi, say,  true, true,  na self-kidnap be di case and di couple go soon face court afta investigation finish.

Written by: News Author

Rate it

Similar posts

Lagos

Police Grab Four Notorious Cult Boys With Loaded Guns Inside Ojo

Lagos State Police Command don catch four men loaded with guns and bullets inside one hotel for Ajanmgbadi, Ojo area. According statement wey Police tuk, tuk, ABIMBOLA ADEBISI, release, Di suspects Emmanuel Nwokolo, Ayola Israel, Ebuka Nnamdi, and Chinedu Okafor, confess say dem belong to di dreaded Aiye Confraternity and […]

todayJune 2, 2026 13


WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds