Listeners:
Top listeners:
KonfamFM 89.5 We Dey For You
Nigeria Police Force talk say dem don rescue five people wey kidnappers carry, kill five suspected kidnappers, and recover plenty guns and ammunition during recent operations for Kebbi and Abia states. For one statement wey dem release on Tuesday, Force Public Relations Officer, Olumuyiwa Adejobi, talk say di breakthrough na because police, other security agencies, and local vigilantes work together. For Kebbi State, three people wey dem kidnap for Sangara Village, Shanga Local Government on July 27, police rescue them after dem follow kidnappers track go Shanga Hills. The victims Muhammad Nasamu Namata, 25; Gide Namata, 20; and Hamidu Alhaji Namani, 35 dem free them without injury after gun fight make kidnappers run with gunshot wounds. Another two people, Tukur Bello, 26 and Isyaka Abubakar, 25, police rescue them for Danko/Wasagu Local Government during routine patrol on August 15. Dem bin kidnap on August 9 while dem dey graze cattle for Gairi Forest, Zamfara State, but dem don reunite dem with their family.
For Abia State, police use correct information go kidnappers’ hideout for Umuiku Obete Village, Ukwa West Local Government. The kidnappers wey dey terrorize people around Umuozo Village and Uratta Road fight police, but police kill five of dem. Police recover six AK-47 rifles, 335 live bullets, 14 magazines, five phones, three cutlasses, five jackets, axe, boots, charm and double-barrel long gun from the place. Inspector-General of Police, Kayode Egbetokun, praise police officers for their courage and promise say police go continue to protect life and property. E also urge officers make dem continue strong and fight bad people all over Nigeria.
Written by: News Editor 1
We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.
We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!
Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!
Copyright KONFAM 2025