Sports

Portable Challenge Terry G Make Dem Fight Boxing

todayJuly 20, 2026 9

Background
share close

By: Esther Daniel

Nigerian singer, Portable, don challenge veteran artiste Terry G to one celebrity boxing match, say di fight go help bring Terry G name back inside di spotlight.

Portable talk dis one during interview for tv sit down tuk, wia e say e prefer to fight fellow entertainers instead of social media personalities like VeryDarkMan and Carter Efe.

Di singer also claim say na im start celebrity boxing for Nigeria and say e don make millions of naira from previous fights.

Portable come tuk say e don ready for im July 31 rematch wit actor Charles Okocha for Lagos and believe say plenty people go come watch di bout.

Written by: News Editor 2

Rate it

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds