By : Jolayemi Olajide
Normally election time na time for promises and na so NDC popular candidate Peter Obi take go promises say im na one term e run if Naija make am president.
Im yarn dis one on wednesday for interview, day never break reactions don dey trail di mata.
According to Presidency, through Special Adviser to di President on Information and Strategy Bayo Onanuga, on Thursday for X, say Obi political history no show consistency or trustworthiness.
Onanuga say Obi past political moves show pattern wey dey question di credibility of di promise.