By: Esther Ayoola
President Bola Tinubu don direct all APC governors for di 31 states say make dem ensure say party primaries dey free, fair and as dem follow Electoral Act.
Him tuk dis one afta a close door meeting with APC govos for State house, Abuja, say di aim na to keep di unity and togetherness.
Explaining wetin dem discuss for di meeting, Kwara State Governor AbdulRahman AbdulRazaq and Niger State Governor Mohammed Bago touch light every say baba seyi don give im governors power to conduct fair primary elections across di obodo Naija.