Edited by Ebi Oboko
Wi oga Presido, Bola Tinubu don express joy as security agencies rescue di school pikin dem and teachers wey kidnappers hold for 56 days for Oriire community, Oyo State.
Baba Seyi hail di military, DSS and Nigeria Police for di successful operation wey lead to di arrest of eight suspected kidnappers while security operatives neutralise oda gang members.
Tinubu also sympathise with di victims and dia families over di trauma wey dem pass through during dia captivity.
E still praise Oyo State Government for working with di Federal Government and urge di state to tighten security around schools to stop future attacks.