Listeners:
Top listeners:
play_arrow
KonfamFM 89.5 We Dey For You
President Bola Tinubu don sign the 2026 Appropriation Bill into law, wey approve ₦68.32 trillion spending for Nigeria 2026 fiscal year.
Di presidency announce dis ogbonge update on Friday for official statement wey Special Adviser on Information and Strategy, Bayo Onanuga sign, say dem also extend 2025 budget implementation from March 31 go June 30, 2026.
Di budget include ₦4.799 trillion for statutory transfers, ₦15.8 trillion for debt service, ₦15.4 trillion for recurrent spending, and ₦32.2 trillion for capital projects.
Dem explain say di extension and new budget go help gornment continue projects and manage national spending better for di current economic plan.
Written by: Ridwan Agbomeji
budget deadline extentionn Naija 2026 Budget Presidency President Tinubu State House news update
We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.
We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!
Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!
Copyright KONFAM 2026