obodo oyinbo

President Trump Slash India Tariff Go 18% From 50%

todayFebruary 3, 2026 2

Background
share close

By: Esther Ayoola

President Donald Trump don drop ogbonge update, say US go cut tariff wey dem dey charge Indian goods from 50% to 18% afta meeting with Prime Minister Narendra Modi.

India come agree say, dem nor go dey buy Russian oil again and dem go dey buy oil from US and maybe Venezuela.

According to Trump, dis waka with India go reduce trade barriers and India go dey buy plenty American things like energy, technology and farm goods.

Written by: News Author

Rate it

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app