OBODO NAIJA

Presido Tinubu To Hold Police Council Meeting To Konfam Disu As New IGP

todayMarch 2, 2026 3

Background
share close

Say wi oga Presido Bola Tinubu don dey press cloth to hold Nigeria Police Council meeting on Monday for Abuja to touch light Olatunji Disu as new Inspector-General of Police.

One oga for Presidency yan say, di Police Council Meeting na Monday, while another senior police source confirm am on Saturday, say dem dey plan am around 12:00 or 1:00 pm.

Di meeting dey follow Police Act 2020 wey say, council must approve before President send name go Senate.

Nor Be Amebo dat, Presidency say after former IGP Kayode Egbetokun resign last Tuesday, dem go do council meeting quickly to konfam di new appointment.

 

Written by: Ridwan Agbomeji

Rate it

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app