obodo oyinbo

Prime Minister Albanese Insist Say, Australia No Go Rescue ISIS Woman An Pikin From Syria

todayFebruary 17, 2026 3

Background
share close

By: Esther Ayoola

Australia Prime Minister Anthony Albanese don clear mata say im govament no go support any jaguda doings and dat  Australian  go send  woman an pikin wey get tie  with ISIS fighters.

Untop tuk tuk with tori pipo on Monday, Oga prime minister say e dey “unfortunate” say pikin dem dey involved, but Australia no go look back on dia decision.

Albanese say any person wey use im two eyes join ISIS, terrorist group, make dem face di wahala wey go come with am.

Also untop yanings for social media Australia Home Affairs Minister spokesperson repeat di same tuk say, any person wey return from Syria after the ISIS mata,  go sti  face di  law for Australia.

Written by: News Author

Rate it

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app