By : Joayemi Olajide
Private sector pipo don raise alarm say make nobody force dem to pay N100,000 minimum wage like some states dey do.
Business groups yarn say na only few big companies fit afford am, while small and medium shops dey suffer inflation, fuel wahala, light bill and customer scarcity.
Di warning land as talk dey fly about new general minimum wage, with some governors already lifting workers pay.
As LCCI boss Leye Kupoluyi clear am, “gornment no fit force pocket wey no full,” so private employers dey beg make dem no carry load wey pass dia strength.