By: Esther Ayoola
Pipos Redemption Party (PRP) don explain why, Peter Obi and Rabiu Kwankwaso no join dem, say na based on say dem nor guarantee dem presidential ticket.
PRP chairmo, Hakeem Baba-Ahmed naim do explanation for TV sit down tuk, say INEC delaying dia national executive approval sef, join di badness.
Obi and Kwankwaso, wey be Labour Party and NNPP 2023 presidential candidates, sha later join Naija Democratic Congress (NDC).