National

PRP Welcome Ex-LP VP Candidate Baba-Ahmed to Party Fold

todayApril 30, 2026 1

Background
share close

By: Esther Ayoola

Peoples Redemption Party don officially welcome former Labour Party vice-presidential candidate Hakeem Baba-Ahmed into dia party fold.

Di announcement come on Thursday for Abuja, as party National Publicity Secretary Muhammed Ishaq tuk say Baba-Ahmed join na big boost for dia plan to build better and prosperous Naija.

According to Ishaq, Baba-Ahmed entry na “new dawn” wey go help strengthen dia push for good governance, better security and economic growth.

Di party sti tuk say him supporters across the country go help increase dia strength and push dia vision for national renewal.

Written by: News Author

Rate it

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds