By: Esther Ayoola
For Abuja, after all the drama for Osun state between the dancing senator and first lady, Oluremi Tinubu, madam first lady don wire birth messgae give Adeleke wife, Titilola Adeleke, as she clock 60.
Na for statement wey dem wrap like moimoi drop for her x page, mama Remi hail madam Adeleke for the serious work wey she dey do to uplift Osun people through the renewed hope initiative.
She talk say the Osun first lady dedication don turn many lives around and her impact dey show everywhere for the state.
To crown the ogbonge greeetings, Oluremi throway better salute wey get odour give governor Ademola Adeleke, the celebrant children and entire family.