Russia don fire missile enter di capital of Ukraine, even as dem tok say dem ready to start discussay to stop di war.
Kyiv Mayor, Vitaliy Klitschko, tok say di attack wey happen for Wednesday night spoil many houses and wound six pipu.
Donald Trump pipu , Steve Witkoff and Jared Kushner, dey try hellep Russia and Ukraine make peace as Witkoff meet Russia Presido, Vladimir Putin, on Wednesday, one day after e meet Ukraine leader.
Trump tok say dem don dey near to end di war, but Russia and Ukraine still dey fight.