By: Rilwan Agbomeji
Di story dey worwor every day for Iran, say Iran UN ambassador don go put accusation forĀ US Presido, Donald Trump head, dat Trump dey look for Iran trouble dey encourage violence.
U sabi say, Trump for media yarn say di endgame na to win Iran and make dia pipo protest and take control of di govment.
Internet don off for Iran for pass five days as protests continue.
European countries don call dia Iranian ambassadors for di complain, while Russia say foreign people no suppose dey interfere for Iran politics.