By: Esther Ayoola
Lagos State Govnor, Babajide Sanwo-Olu, don come out clear tuk wey no true on top beef marras between am and Ogun State govrnor, Prince Dapo Abiodun. Na lie lie tuk, according to am.
Di Govo yarn di tori straight for statement wey im media oga, Gboyega Akosile, drop yesterday.
Sanwo-Olu con yarn say, make people calm down because nothing like dat dey happen at all, say both of dem still dey work together well well as leaders and neighbours.