National

Shettima Hail NELFUND As Lifeline For Poor Students

todaySeptember 10, 2026 2

Background
share close

By: Ayobami Dada

Vice Presido, Kashim Shettima don tok say di Nigerian Education Loan Fund, NELFUND, as landmark programme wey don give poor families better financial relief and remove money wahala wey dey stop students from going higher school.

Di Vice Presido tok dis one on Wednesday for statement wey Senior Special Assistant to di President on Media and Communications, Stanley Nkwocha, release, after Shettima receive University of Abuja management team led by Vice-Chancellor, Prof. Hakeem Fawehinmi.

Shettima say di fund wey Presido,  Bola Tinubu administration set up don become important way to hellep poor pipu, reduce poverty and push education forward for Nigeria.

According to am, NELFUND don make sure say poverty no longer be reason why students from poor homes no fit enter tertiary institution, as di scheme dey pay school fees and also give students monthly upkeep money.

Written by: News Editor 2

Rate it

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds