By: Rilwan Agbomeji
Based on di gbege wey dey inside di People’s Democratic Party, anoda set of PDP law makers precisely from Rivers State don buy waka enter di All Progressives Congress.
Dis announcement follow di law makers sitting on Tuesday for Abuja.
Di law makers include Solomon Bob, Victor Obuzor, Dumnamene Dekor, Cyril Hart, Blessing Amadi and Felix Nwaeke.
According to source from di National Assembly, all six of dem be loyalist to Federal Capital Territory Minister, Nyesom Wike.