Listeners:
Top listeners:
play_arrow
KonfamFM 89.5 We Dey For You
Lagos State Government don warn residents across di state make dem fully join di monthly environmental sanitation wey dem fix for Saturday, April 25, or dem go collect wotowoto.
Di Commissioner for Environment and Water Resources, Tokunbo Wahab, drop di warning for statement on Wednesday, say make residents for all five divisions of Lagos stay for house between 6:30am and 8:30am to clean dia surroundings.
Im talk say residents suppose clean dia environment and clear all drains for front of dia house before dem go about dia daily waka.
Tokunbo Wahab still add say government don plan well well for di exercise, as big big trucks don already dey everywhere across di state to carry waste comot.
Written by: Rilwan Agbomeji
Lagos environmental sanitation April 2026 Lagos sanitation warning Lagos state SANITATION Tokunbo Wahab sanitation order
We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.
We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!
Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!
Copyright KONFAM 2026