By: Rilwan Agbomeji
Liverpool manager, Arne Slot say liverpool marraigae with Salah never sti finish normal, and that im go sit down Salah tuk mata as e dey be.
U sabi say Salah, wey be 33 years old, vex say dem leave am out of di Champions League game against Inter Milan afta Liverpool draw 2-2 for Leeds, and e complain say e dey throw under di bus by di club.
Slot talk say na normal tin say player go vex say im nor dey play, but nor go tuk anything until im see Salah one on one and tuk,before im go clear di public wetin go sup.