By; Emmanuel Ariyo-David
Federal High Court for Abuja don shift ruling till June 30, 2026, say na dia, dem go hear di bail application of senior man activist and publisher Omoyele Sowore
Justice Mohammed Umar take di decision after both sides adopt dia processes for di mata.
On June 16, di court revoke Sowore bail and order make dem arrest am after e no show for court over allegations of cybercrime and criminal defamation.
DSS dey prosecute am over claims say e call President Bola Tinubu “criminal” for posts wey e put for im official X and Facebook pages.