By: Esther Ayoola
Super Falcons captain Rasheedat Ajibade and goalkeeper Chiamaka Nnadozie don voice dia frustration say di team nor get any friendly matches to play for dis international play.
Dis FIFA women international window start on April 7 go reach April 18, wey suppose allow teams play at least three friendly games.
But Naija Football Federation never sti announce any match for di Naija women’s national football team, and normally say dem suppose to dey prepare for di WAFCON
U sabi say, initial plans to play Togo and Cape Verde friendlies collapse, and dat dis development nor dey sweet di Falcons for belle at all.