2026 FIFA World Cup

32 Results / Page 2 of 4

Background

Sports

Spain Tear Austria Apart 3-0 To Enter Last-16

Spain paint Los Angeles red as dem sample sweet football block Austria comot for World Cup inside America on Thursday. Mikel Oyarzabal score two goals and Pedro Porro use header finish di job as di European champions tear Austria apart 3-0 for di round-of-32 knockout match. Big Hollywood stars like Penelope Cruz, Javier Bardem, and singer RosalĂ­a all show up for SoFi Stadium to cheer Spain as dem dominate the […]

todayJuly 3, 2026 12 2

Sports

Everywhere Choke As 2026 FIFA World Cup Round of 16 Dey Near

As e be like dis, na only 10 countries don already secure dia place for 2026 FIFA World Cup Round of 16, as di battle for di trophy dey hot. Di latest teams wey qualify na USA, England and Belgium as dem beat dia opponents yesterday. Di other teams wey don book dia tickets to di last 16 na France, Brazil, Norway, Morocco, Paraguay, Canada and Mexico. And later dis […]

todayJuly 2, 2026 14

Sports

Mbappe And Olise Shine As France Brush Sweden

By: Yusuf Abuh France pull weight for World Cup as dem beat Sweden 3-0 on Tuesday to enter tdi round of 16 match where dem go face Paraguay. Kylian Mbappe score two goals inside di heavy match inside MetLife Stadium for New Jersey, and di first goal enter small time before half-time after France hit post two times. Michael Olise ball wetin nor good, for di match as na im […]

todayJuly 1, 2026 34 1

Sports

How Germany Disgrace Dia Village Pipo For World Cup

Germany don do surprise crash out of di World Cup afta Paraguay beat dem 4-3 for penalty shootout, say both teams play 1-1 for regulation and extra time on Monday. Julio Enciso naim score first for Paraguay before Kai Havertz equalise for Germany with im third goal of di tournament. VAR con cancel Jonathan Tah extra-time goal, as Paraguay hold strong reach penalty shootout. Goalkeeper Orlando Gill save two German […]

todayJune 30, 2026 10

Sports

Late Goal Carry Canada Enter World Cup Round 16

Canada don qualify for World Cup last 16 for di first time after Stephen Eustaquio score late winner wey give dem 1-0 victory against South Africa on Sunday for di first knockout match. Di game bin dey wan enter extra time oh, before Eustaquio fire one fine shot from outside di box for stoppage time to break South Africa heart. Canada, wey dey co-host di tournament, go now face either […]

todayJune 29, 2026 10

Sports

Mourinho Back England To Win 2026 World Cup

By: Yusuf Abuh Real Madrid coach Jose Mourinho drop micro soft word  say England get strong chance to win the 2026 FIFA World Cup. Mourinho tell Beast Mode On Podcast say e believe England get the quality to carry the World Cup trophy. England start dia campaign with 4-2 win over Croatia before dem play 0-0 draw with Ghana for Group L. Dem go play Panama for dia final group […]

todayJune 26, 2026 43

Sports

Ecuador Surprise Germany 2-1

By: Yusuf Abuh Unto world cup updates, Ecuador  shock Germany 2-1 for dia last Group E match on Thursday to qualify for World Cup last 32. Germany naim score first through Leroy Sane, but Nilson Angulo equalise before Gonzalo Plata score di winning goal with 13 minutes remaining. Di victory give Ecuador four points, enough to enter di knockout stage as one of di best third-place teams. Ivory Coast too […]

todayJune 26, 2026 20

Sports

Switzerland Win Canada, South Africa Shock Korea

By: Yusuf Abuh Switzerland don finish top of Group B afta dem beat Canada 2-1 for dia last group match. Ruben Vargas and Johan Manzambi score for Switzerland before Promise David pull one back for Canada, but di Swiss side hold on to collect di win. For Group A, South Africa shock South Korea 1-0 as Thapelo Maseko score di only goal of di match as dem reach di knockout […]

todayJune 25, 2026 17

Sport Yarns

FIFA World Cup Golden Boot Race Hot

By : JolayemI Olajide Race for the 2026 FIFA World Cup Golden Boot don hot up after second round of group-stage matches finish, with Argentina captain Lionel Messi leading the scorers table. The eight-time Ballon d’Or winner don score five goals and never record any assist so far. Messi start the tournament with hat-trick before adding two more goals for Argentina second group game.

todayJune 24, 2026 24

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds