2026 FIFA World Cup

32 Results / Page 3 of 4

Background

Sports

England And Ghana Share Point

By: Yusuf Abuh England and Ghana play 0–0 draw for tight Group L match, as both sides battle hard but nobody fit break goal for either end. England national football team control possession plenty, but Ghana national football team stay very compact for back and block all central attack well well. England get big chance for 18th minute when Harry Kane try finish from close range, but Ghana defence clear […]

todayJune 24, 2026 12

Sports

France And Argentina Cruise Enter Next Round For 2026 World Cup

By: Yusuf Abuh   Unto world cup update, France national football team don show again say dem no come World Cup to con joke as dem beat Iraq 3–0,  wey make dem move to di  next round, Mbappe score two goals and Dembele naim collobi di last one. Meawhile, Argentina sef do dia own for one conner, dem settle down beat Austria 2–0,  with Messi scoring two goals. For another […]

todayJune 23, 2026 17

Sport Yarns

Argentina, France Set for Big World Cup Clash Against Austria and Iraq Tonight

By : Jolayemi Olajide Unto di World cup update, Argentina dey face Austria for dia World Cup Group J match today by 6 p.m. Nigerian time. While France go also meet Iraq for Group I clash by 10 p.m. Nigerian time, with Kylian Mbappé and im teammates ready to push for another victory. Both matches go be big test as teams dey try secure beta position for dia group stage […]

todayJune 22, 2026 13

Sports

World Cup Shock as Belgium and Iran Draw Goalless

For World Cup matches on Sunday, Belgium and Iran play very tough game wey end 0–0 as both teams no fit find breakthrough. Uruguay and Cape Verde follow play correct football wey end 2–2, with Cape Verde again show say dem no be underdog wey people fit just push aside. Di results show say big teams no fit relax again as smaller nations dey challenge dem well-well for pitch.

todayJune 22, 2026 15

Sports

Canada Wipe Qatar 6-0

For World Cup yesterday, Canada show serious strength as dem hammer Qatar 6–0, completely dominate di match from start to finish. Still yesterday, Bosnia and Herzegovina try but Switzerland overrun dem 4–1, especially for second half . Canada victory na clean attacking performance with plenty goals and no reply from Qatar, while Bosnia struggle to contain Swiss pressure all through di game.

todayJune 19, 2026 13

Sports

England Open World Cup With 4-2

England don begin dia World Cup journey, with dramatic 4-2 win over Croatia for one very entertaining match. Harry Kane score two goals, including penalty and header, to help England take early lead before Croatia equalise twice for first half. Jude Bellingham later score just after halftime to put England ahead again. England con hold dia ground well for defence and add more pressure to seal di victory in di […]

todayJune 18, 2026 11

Sports

Mbappé Score Brace As France Beat Senegal

Unto world cup update, France don go show Senegal pepper, wining dem 3-1 for Group I World Cup match wey hapun for New York/New Jersey Stadium on Tuesday. Kylian Mbappé score two goals, including correct long-range strike for 96th minute, take make hin total World Cup goals reach 14 and also become France highest goal scorer with 58 goals. Bradley Barcola con add another goal for France, while Senegal manage […]

todayJune 17, 2026 15

Sports

South Africa Finish With 9 Men 

Mexico don show workings, start dia 2026 World Cup journey with 2–kondo win over South Africa for opening match wey hapun for Estadio Azteca. Na so south Africa players eavy for ground, nor fit carry body for di game, na so Mexico take advantage, three red cards come out, make South Africa finish with nine players for field. Julian Quinones naim score di first goal for di tournament while Raul […]

todayJune 12, 2026 13

Sports

Omar Artan Return Mogadishu For Hero Welcome

Somali referee, Omar Artan, wey United States deny entry for World Cup duty, don come back Mogadishu for hero welcome on Wednesday as supporters gader for airport wave flag greet am. Artan tuk say e no go give up, promise say e go still participate for 2030 World Cup despite di rejection. di referee land for Mogadishu main airport through Turkish Airlines flight, where more dan 100 fans celebrate am […]

todayJune 10, 2026 15

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds