ADC

29 Results / Page 2 of 4

Background

Lagos

ADC Candidate Blasts Lagos Over Rising Waste

By: Kofoworola Olayinka ADC candidate Ayodele Adio don slam Lagos Gornment over worsening waste management across di state. Adio talk say gornment suppose don plan for rising waste based on population growth, urbanisation and business activities. Im react to Deputy Govo comment say waste operators dey handle more refuse dan dem expect. Adio call for betta waste planning, modern collection systems, recycling and stronger gornment accountability. SEO tags: Ayodele Adio, […]

todayAugust 13, 2026 22

Politics

Atiku Tear Ground, Say “Na Me Carry Obasanjo For Head After Prison!”

By : Jolayemi Olajide ADC presidential candidate and former Vice Presido Atiku Abubakar don hit back at former Presido Olusegun Obasanjo, tok say after Obasanjo regain freedom from prison with little to im name, na him receive am, cloth am, care for am and make sure say e no lack anything. Atiku, through statement wey im Senior Special Assistant on Public Communication, Phrank Shaibu, release, tok say e react with […]

todayAugust 1, 2026 25

OBODO NAIJA

Kenneth Okonkwo Tell Tinubu Say INEC Never Prove Dia Self

By: Esther Daniel ADC big man Kenneth Okonkwo don blast oga presido  Bola Tinubu over him defence of INEC, say di electoral body never prove to Nigerians say dem dey fair and neutral. Okonkwo react after Tinubu talk am on Tuesday during meeting with Catholic Bishops for State House, Abuja, where di presido defend di commission. Tinubu insist say INEC still dey independent and say people wey dey question dia […]

todayJuly 31, 2026 11

OBODO NAIJA

ADC Question Tinubu Fitness, Raise Alarm Over Gornment Appointment Wahala

By: Esther Daniel African Democratic Congress (ADC) don raise alarm over wetin e describe as appointment wahala for Presido Bola Tinubu administration. Di party say National Assembly suppose investigate whether di Presido still dey fit to perform di duties of im office. According to statement wey National Publicity Secretary, Bolaji Abdullahi, sign, one man wey presidential directive remove from office still dey occupy di position and hold meetings with top […]

todayJuly 17, 2026 27

OBODO NAIJA

Court Back David Mark As ADC Leader

Di Federal High Court for Abuja don back David Mark branch as di correct leader of di  opposition party, African Democratic Congress (ADC). Justice Musa Liman throway di case wey one House of Reps member, Leke Abejide, file, according to di court senior man, dem nor get power to put mouth for political party inside house wahala. Former Vice-President Atiku Abubakar don  hail dis judgment,  say di ruling na big […]

todayJuly 3, 2026 22

Lagos

Gbadebo Rhodes-Vivour Dey Prepare For 2027 Lagos Governorship Race

Gbadebo Rhodes-Vivour of di African Democratic Congress (ADC) don clear say him 2027 Lagos governorship ambition no depend on Peter Obi or di Obidient movement. Di politician tok dis one for one siddon tuk on Thursday, as e emphasize say e don dey build strong structure for grassroots communities. Rhodes-Vivour explain say e don work hard to connect with Lagos residents wey dey face challenges like demolition, and e believe […]

todayJuly 2, 2026 22

Politics

David Mark jinger boys say ADC court judgement nor go work

By : Jolayemi Olajide Senator David Mark, wey be the National Chairman of ADC, don tell party members say no sakement for di Justice Lifu judgement wey commot dia name for di 2027 election. Mark tell the party candidates for Abuja say the judgement na "arrow wey dem fire for Nigeria democracy heart," but e promise say higher courts go soon cancel di decision. Di one pain David Mark, na […]

todayJune 16, 2026 25

OBODO NAIJA

Okonkwo Drag ADC Over VP Choice

African Democratic Congress chieftain, Kenneth Okonkwo don criticize di party decision to pick Vice Presidential candidate from South-South for 2027 election. Im tuk dis one for TV sit down tuk say, di move fit worsen di political marginalisation wey South-East dey face since 1999, as dem never produce Presido or Vice Presido. Okonkwo also yarn say if ADC really choose candidate from South-South, e no go show fairness to other […]

todayJune 16, 2026 17

OBODO NAIJA

Why Court Wan Wipe ADC From Di 2027 Election

African Democratic Congress (ADC) don reject one Federal High Court judgment wey order INEC to deregister dem and four other political parties. U sabi say, Justice Peter Lifu of di Federal High Court for Abuja give di order on Monday, say di parties no meet constitutional and electoral requirements. Di party Publicity Secretary, Bolaji Abdullahi, naim con sorosoke for statement to reply, post for X, say di judgment dey unconstitutional […]

todayJune 16, 2026 22

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds