Arsenal FC

7 Results / Page 1 of 1

Background

Sport Yarns

Arsenal Finally Break 22-Year Jinx, Carry EPL Title

By: Esther Ayoola Arsenal Football Club don finally win di English Premier League title on Tuesday afta Manchester City draw 1-1 for Vitality Stadium. Dis na di first time for 22 years wey Arsenal go carry di Premier League trophy, afta dem don finish as runners-up for three seasons back-to-back. Manchester City bin need to win to keep di title race alive but dem fall hand beta style. Arsenal go […]

todayMay 20, 2026 10

OBODO NAIJA

Dangote Reveal Why E No Buy Arsenal, Choose Finish $20bn Refinery Instead

By : Jolayemi Olajide Africa richest man, Aliko Dangote, don reveal say e abandon im plan to buy Arsenal F.C. because e need di money to complete im $20 billion refinery project for Lagos. Dangote make di disclosure during one podcast interview with Nicolai Tangen, where e explain say Arsenal value na around $2 billion when e seriously dey consider takeover. Di billionaire businessman talk say at dat time, e […]

todayMay 14, 2026 26

Sport Yarns

Foden Warn Arsenal Say Many Things Fit Happen For Final Day

By : Jolayemi Olajide Manchester City star boy, Phil Foden don yarn warning give Arsenal say Premier League title race fit still go down to final match day before e clear. Foden yarn dis one with Sky Sports after dem beat Crystal Palace 3 Kondo, on Wednesday night. E yarn say, di aim na to keep pushing and to mount pressure on top Arsenal head.

todayMay 14, 2026 12

Sport Yarns

How VAR Hellep Arsenal Escape West Ham Late Equaliser

By: Esther Ayoola Say like dis Arsenal don dey very close to dia first Premier League title in 22 years afta dem beat West Ham 1-0 on Sunday. Leandro Trossard naim score one deflected goal for 83rd minute to settle di tie. Late drama burst when West Ham think say Callum Wilson don equalise afta Raya drop ball for di penalty area. But VAR check show say Pablo foul Raya, […]

todayMay 11, 2026 12

Sports

Arsenal Enter Quarter Final As Chelsea Crash Out For Champions League Battle

By: Esther Ayoola Arsenal show strong hand as dem beat Bayer Leverkusen 2-0 to enter quarter-final of UEFA Champions League. Di North London club carry di tie 3-1 on aggregate afta ogbonge  performance for both legs. Eberechi Eze na im open scoring with Korrect fine goal before halftime. Later, Declan Rice add another goal for second half to seal di win. For Chelsea FC side, dem crash out afta Paris […]

todayMarch 18, 2026 22

Sports

FA Cup Round of 16: Arsenal, Chelsea, Liverpool, Man City Know Opponent

By: Esther Ayoola Premier League big clubs Arsenal, Liverpool, Chelsea and Manchester City don sabi who dem go play for FA Cup Round of 16. Arsenal go play lower league team Mansfield Town, while Chelsea go face Wrexham. Manchester City go play Newcastle United, and Liverpool go rugged Wolves wey dey try avoid relegation. Other games na Fulham vs Southampton, Sunderland go play Port Vale or Bristol City, Leeds go […]

todayFebruary 17, 2026 22

Sports

Man City Face Liverpool Another Opportunate For Arsenal To Pull Clear

By: Esther Ayoola Arsenal fit take another big step towards di Premier League title if dem beat Sunderland dis Saturday, tuk di club officials. Di Gunners don already get six-point lead for top table as dem dey close to win di first league since 2003/04. Aston Villa still dey behind top two, but di dip in form for Unai Emery side don allow Manchester United, Chelsea, and Liverpool dey fight […]

todayFebruary 6, 2026 32 17

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds