ARSENAL

9 Results / Page 1 of 1

Background

Sport Yarns

Arsenal Finally Break 22-Year Jinx, Carry EPL Title

By: Esther Ayoola Arsenal Football Club don finally win di English Premier League title on Tuesday afta Manchester City draw 1-1 for Vitality Stadium. Dis na di first time for 22 years wey Arsenal go carry di Premier League trophy, afta dem don finish as runners-up for three seasons back-to-back. Manchester City bin need to win to keep di title race alive but dem fall hand beta style. Arsenal go […]

todayMay 20, 2026 9

Sports

Haaland Early Goal Carry Man City Go Top of EPL Table

Erling Haaland score as Manchester City beat Burnley 1-0 for Turf Moor, take jump pass Arsenal for top of  Premier League table. Di win also confirm say Burnley don go back to Championship. Even though City try anoda 28 shots, dem no add another goal as Haaland and Cherki even hit post. Arsenal fit still return top if dem beat Newcastle, but for now na City dey lead di table.

todayApril 23, 2026 15 25

Sports

Arsenal Title Hope Dey Fade – Mikel Obi

Former Chelsea midfielder John Obi Mikel say like dis Arsenal don dey run out of ideas for Premier League title race after dem lose 2-1 to Bournemouth for Emirates. Di result make dem still get 6 points lead, but Manchester City don close gap with a strong 3-0 win over Chelsea. City fit even level Arsenal if dem win dia outstanding match and also beat Arsenal for dia next league […]

todayApril 15, 2026 15

Sports

Fear Grip Arsenal Fans As City Close EPL Title Gap

By: Esther Ayoola Say like dis now, Arsenal fans dey worry as title race don dey tight afta dem lose 2-1 to Bournemouth for Emirates Stadium. Di defeat mean say dia lead don reduce to just six points with Manchester City sti getting one match in hand. City no waste time as dem beat Chelsea 3-0 to show say dem sti dey serious for di race. If City win dia […]

todayApril 13, 2026 16

Sports

Former Arsenal Star, Gallas Name Di Cup Wey Arsenal Fit Win

Former Chelsea and Arsenal defender William Gallas tuk say di only trophy wey Arsenal fit win dis season na di Premier League. Dem bin dey try for quadruple, but dem lose Carabao Cup final to Manchester City. Now, Mikel Arteta side, dey fight for Premier League, FA Cup and Champions League. Gallas say e no believe say Arsenal fit win all three trophies dis season.

todayApril 3, 2026 17

OBODO NAIJA

Spain Release Arsenal Midfielder Zubimendi Over Knee Wahala

Spain don release Arsenal midfielder Martin Zubimendi from dia squad. According to Spain Football Federation  on Sunday,  say na to protect im health and avoid any serious pain to di knee. Zubimendi play small as substitute for Spain 3-0 win over Serbia on Friday. Im nor go play friendly against Egypt for Barcelona on Tuesday.

todayMarch 29, 2026 16

Sports

Man City Beat Arsenal 2-0 To Carry League Cup

Manchester City don win dia first trophy for dis English season as Nico O’Reilly score two goals for di second half to hellep dem beat Arsenal 2-0 for di League Cup final. Arsenal wey be Premier League leaders come as favourites, but power pass favourite for Wembley stadium. Di first half no too get action, but O’Reilly first goal come after Arsenal goalkeeper Kepa Arrizabalaga fumble. Four minutes later, O’Reilly […]

todayMarch 23, 2026 13

Sports

Kai Havertz Last-Minute Goal Send Arsenal Go Carabao Cup Final

By: Esther Ayoola Arsenal don konfamat demself for Carabao Cup final afta dem beat Chelsea 1‑0 for Emirates Stadium on Tuesday night.   Di match no too get chance, but for last minute of six minutes added time, late goal from Kai Havertz ni wunjure Chelsea for ground.   Dis goal give Arsenal di 1‑0 win for di match and 4‑2 for aggregate, make Chelsea cry beta style.

todayFebruary 4, 2026 20 1

Sports

Arsenal Don Reward Keeper Raya With Better Deal

Arsenal don reward dia goalkeeper David Raya with better contract to show say e be one of Mikel Arteta key men. Di Spain international don finalize beta terms wey give am pay raise on top di contract wey e sign when e join di club permanently for summer 2024. Di agreement bin happen earlier dis summer but Arsenal never announce am officially. Before di new deal, Raya dey collect about […]

todayOctober 8, 2025 30

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds