By: Mariam Ajayi
Arsenal don continue dia flawless run for Premier League as dem knack Aston Villa 1-0 for Villa Park on Monday night.
Na Bukayo Saka score di single goal for second half to give di Gunners full three points and keep dia clean-sheet record intact.
Dis win na di perfect way for Mikel Arteta to celebrate hin 250th Premier League match as Arsenal gaffer.
Arteta maintain di exact same starting eleven wey dem use wallop Coventry 3-0 for season opener, and di team don clear signal say dem dey ready to defend dia title.