Champions League

11 Results / Page 1 of 2

Background

Sports

Flick Back Yamal for Ballon d’Or

By: Ayobami Dada Barcelona coach Hansi Flick don back Lamine Yamal to win di 2026 Ballon d’Or after di teenager shine for Barcelona 5-1 win over Feyenoord for Champions League. Flick say Yamal na exceptional and special player, adding say e deserve to win di award this year. Yamal dey among di 30-man shortlist for di Ballon d’Or, after helping Barcelona win LaLiga and Copa del Rey last season. At […]

todaySeptember 10, 2026 10

Sports

UEFA Go Honour Nepal Flood Victims Before UCL Matches

By: Damilola Adekunle UEFA go honour victims of di deadly floods wey hit Nepal before all Champions League matches dis week, with one-minute silence and special banner. Di football body say di banner go carry message “You are not alone Nepal”, as European football family show support to victims and dia families. Di 2026/27 Champions League league phase go start Tuesday, September 8, with 36 teams set to battle across […]

todaySeptember 7, 2026 13

Sports

PSG Coachie Luis Enrique Rake Say na Title Dem Dey go For

By: Yusuf Abuh Nor be small tin oh, Paris Saint-Germain coachie Luis Enrique say di European champions sti dey hungry oh to win everything dis season, as dem prepare face Aston Villa for UEFA Super Cup final on Wednesday. PSG carry dia second straight Champions League title last season, alongside dia fifth consecutive Ligue 1 crown and oda trophies. Luis Enrique team go open dia new season for Salzburg against […]

todayAugust 12, 2026 21

Sport Yarns

CAF Confirm Rangers, Rivers United for Champions League Qualifier

By : Jolayemi Olajide Confederation of African Football (CAF) don confirm say Enugu Rangers and Rivers United go represent Nigeria for di qualifying rounds of di 2026/27 CAF Champions League. According to di list wey CAF release on Monday, 24 clubs from 12 African countries go compete, with each country providing two teams. Defending champions Mamelodi Sundowns of South Africa, Zamalek, Pyramids, TP Mazembe, Orlando Pirates, Esperance and oda top […]

todayJuly 7, 2026 29

Sports

Lookman Hail Atletico After Dem Beat Barcelona

Ademola Lookman don hail Atletico Madrid Champions League victory against Barcelona on Wednesday inside Camp nou. Lookman say na good result, especially as dem no concede any goal for there and im team show workings based on dia unity. On di other hand, Barca coachie, Hansi Flick yarn for post match interview say im team play well for first and second half even with less players. E sti add say […]

todayApril 9, 2026 30

Sports

Mbappe Set To Shine As Madrid Face Bayern For UCL Clash

Real Madrid coachie Arbeloa don konfamate say, star boy, Kylian Mbappe go dey available for di Champions League clash with Bayern Munich on Tuesday. For Pre match conference, Di Coachie explain say Mbappe na very important player for di team. Mbappe wey be their top scorer nor start di last games against Manchester City because of knee injury, but di team still win wella. Now wey e don recover, coach […]

todayApril 6, 2026 32

Sports

Former Arsenal Star, Gallas Name Di Cup Wey Arsenal Fit Win

Former Chelsea and Arsenal defender William Gallas tuk say di only trophy wey Arsenal fit win dis season na di Premier League. Dem bin dey try for quadruple, but dem lose Carabao Cup final to Manchester City. Now, Mikel Arteta side, dey fight for Premier League, FA Cup and Champions League. Gallas say e no believe say Arsenal fit win all three trophies dis season.

todayApril 3, 2026 23

Sports

Mbappe Net Four Goals As Madrid Beat Olympiacos Vinicius Shut Doubters

Kylian Mbappe deliver one ridiculous four-goal show wey carry shaky Real Madrid beat Olympiacos 4-3 for Champions League on Wednesday night. Di Frenchman continue im crazy form, while Vinicius Jr help calm di tension after one week of controversy as e grab one assist to push Los Blancos to di European win against tough opponents. Madrid start di match poorly as dem no fit create early chances, and Olympiacos punish […]

todayNovember 27, 2025 130

Sports

Lookman, Onyedika Dey Target UCL Survival

Ademola Lookman and Raphael Onyedika go try help dia clubs secure important wins for UEFA Champions League today, Wednesday. Lookman club, Atalanta, dey 17th for table with seven points from four games. Dem go play away game against Bundesliga side, Eintracht Frankfurt. Atalanta gats win di game if dem wan keep hope for knockout round alive. Onyedika club, Club Brugge, go Portugal make dem face Sporting Lisbon. Dem dey 26th […]

todayNovember 26, 2025 40

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds