By : Jolayemi Olajide
World Health Organization officials on Tuesday don warn say Ebola outbreak for north-eastern DR Congo dey spread faster than dem first think.
Dr Anne Ancia of WHO tell newsmen say as dem dey investigate more, dem dey discover fresh cases for different areas around Ituri province, wey be di centre of di outbreak.
Residents for di area talk say na so pipo dey die, die anyhow, say so far, di deadly virus don already kpai 131 pipo and leave more than 513 suspected cases.
Experts from London-based MRC Centre say poor detection of cases fit mean say di real number of infections don pass 1,000 already.