Ebola

5 Results / Page 1 of 1

Background

obodo oyinbo

WHO Release New Treatment Guideline

World Health Organization don release im first complete clinical guidelines for filovirus diseases as Democratic Republic of di Congo dey battle new Ebola outbreak wey come from Bundibugyo virus. WHO talk say di new guideline cover both Ebola and Marburg virus diseases for one document and e give 16 evidence-based recommendations to improve treatment and patient survival. Dem stress say early supportive care and standard treatment methods get serious role […]

todayJune 18, 2026 9

obodo oyinbo

Ebola Spread To New Areas

Ebola cases for Democratic Republic of Congo don rise reach 782, with 178 people don die as di outbreak continue spread. Health authorities yesterday konfam 72 new cases and 29 deaths for Ituri and North Kivu provinces. Di disease don also reach two new health zones, Nia-Nia for Ituri and Mabalako for North Kivu, making di affected areas reach 31. Officials say 359 patients dey isolation or treatment, while 40 […]

todayJune 16, 2026 10

obodo oyinbo

Ebola Spread Enter New Areas For DR Congo

World Health Organization (WHO) on Friday don share update say Ebola don dey spread enter northeastern Democratic Republic of Congo, especially for Ituri, North Kivu and South Kivu. WHO epidemiology head, Olivier le Polain, naim dey give dis update, say di virus dey enter new health zones almost every day, showing how di outbreak big and hard to control. According to WHO, since dem declare di outbreak on May 15, […]

todayJune 12, 2026 12

obodo oyinbo

WHO Give Uganda Big Respect

Di head of di World Health Organization, Tedros Adhanom Ghebreyesus, don hail Uganda as dem dey try well-well to stop di Ebola virus from spreading enter inside dia country. Oga Tedros, wey visit Mulago National Referral Hospital for Kampala on Monday, talk say Uganda really dey handle di matter sharply. Dis praise dey come after WHO declare di Ebola outbreak a heavy international emergency, as di sickness don kpai 91 […]

todayJune 9, 2026 7

OBODO NAIJA

FAAN Tighten Airport Checks Sake Of Ebola

By: Jolayemi Olajide News report: Federal airport authority of Nigeria, FAAN don activate extra safety doings for all international airports for Nigeria to stop Ebola Virus Disease wey don dey scatta body for some parts of Central Africa. For statement wey Director of Public Affairs and Consumer Protection, Henry Agbebire release, im talk say officials don start to screen passengers for Ebola symptoms across di airports. Di agency say dem […]

todayMay 20, 2026 12

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds