FG

5 Results / Page 1 of 1

Background

OBODO NAIJA

State Police: Presidency Set To Sign Am!

Naija don dey move closer to start state police and dat, like dis di Presidency dey move very fast to change di law book wey go make am hapun. Oga Chief of Staff to the President, Femi Gbajabiamila, naim break dis news on Thursday after one major meeting inside State House for Abuja. According to Femi, dis mata don start many months ago after President Bola Tinubu give the order.

todayJune 5, 2026 5

National

FG Explain Why Dem Removes UTME For College Of Education And Poly Agric Courses

By: Esther Ayoola Oga Minister of Education, Tunji Alausa don finally explain why dem remove UTME requirement for colleges of education and some agriculture courses for polytechnics, say na to help increase tertiary school admission by about 1.5 million students. Alausa yarn dis one for TV sit down tuk on Tuesday, say di reform go open more opportunities for Nigerian youths. According to am, gornment remove di UTME requirement for […]

todayMay 13, 2026 8

National

FG, Asuu Don Enter Talks On 40% Pay Rise

Na wah o! Federal Gornment don yarn say dem wan give ASUU lecturers 40% salary increase, according to di pipo wey follow tori pipo talk for Abuja. Dis one land as ASUU leaders dey ready to waka back go negotiation table with Federal Gornment team wey Yayale Ahmed lead, afta dem don finally settle matter and hammer deal for ASUU National Executive Council meeting for Abuja last Sunday. Branch leaders […]

todayDecember 1, 2025 18

National

FG, Labour Union Closed-Door Meeting on NUPENG, Dangote Wahala End Without Agreement

The closed-door meeting wey Federal Government organise to settle beef between Nigeria Union of Petroleum and Natural Gas Workers (NUPENG) and Dangote Group don end without solution. Di meeting wey Minister of Labour and Employment, Mohammed Dingyadi, and Minister of State for Labour and Employment, Nkiruka Onyejeocha, lead, na effort to stop NUPENG planned strike. Di meeting gather NUPENG national executives, officials from Nigeria Labour Congress (NLC), Trade Union Congress […]

todaySeptember 9, 2025 27

National

BREAKING: Nigerian Government Increases Passport Fees

Federal Government don announce say dem go increase the fees wey Nigerians dey pay to get passport. The new prices go start from September 1, 2024. Na wetin the spokesman for Nigeria Immigration Service, A.S. Akinlabi, talk for one statement wey e release on Thursday. Akinlabi talk say the new increase na to make sure say the Nigerian Standard Passport wey go start from September 1, 2025, get better quality […]

todayAugust 28, 2025 30

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds