FOOTBALL

12 Results / Page 1 of 2

Background

Sports

Three Barcelona Players Don Return to Training After World Cup Break

By: Esther Daniel Barcelona players Joan Garcia, Eric Garcia and Anthony Gordon don return to training for di first time after dia World Cup break, as dem begin preparation for di new season. Di three players, wey represent Spain and England for di World Cup, train for weekend alongside Gavi through gym work and ball exercises. Di rest of di Barcelona squad get rest after di triangular tournament for Udine, […]

todayAugust 10, 2026 15 4

Sports

Bonfrère Jo Cry Out Say Nigeria Never Reward Am For Atlanta ’96 Gold

Former Nigeria Dream Team coach Bonfrère Jo don break table oh say 30 years after e lead Nigeria win Africa first-ever Olympic football gold for Atlanta 1996 Olympic Games for Georgia, USA, Nigerian gornment never recognise or reward am for di historic achievement. Di 80-year-old Dutch coach porpoly dis mata for interview give nes tatfos on Monday,  say while many players collect national honours, cash and houses, e nor receive […]

todayAugust 4, 2026 13 1

Sports

Ekong Confess Say E Still Dey Miss Super Eagles

Former Super Eagles captain William Troost-Ekong don tuk say e still dey miss life with di national team even afta he retire from international football for December 2025. Di 32-year-old defender wey serve Nigeria for about 10 years tuk dis one for podcast roundtable wey him join with players like Ola Aina, Alex Iwobi, Joe Aribo and Calvin Bassey. Ekong tuk say E no regret im decision to retire, but […]

todayJune 17, 2026 11

Sport Yarns

Iran players to Miss World Cup Match cause of Expired Visa to America

By : Jolayemi Olajide Iran national football team don dey complain say one of dia star players, Mehdi Torabi, visa don expire after dia match for Los Angeles. According to di aproko, Torabi only get single-entry visa, unlike im oda teammates wey get multiple-entry, so now e nor fit enter di US again to continue di tournament. Iran Football Federation don already start work to see how dem go quickly […]

todayJune 16, 2026 14

Sports

Kano Pillars Release Eight Players

Kano Pillars Football Club don announce say eight players go leave dia club as dia contracts expire for end of 2025/2026 NPFL season. Di players include Muhammad Galadima, Ugochukwu Gabriel, Zahraddeen Bello, Williams Ayuba, Bernard Ovoke, Christian Izuchukwu, Sudais Ali Baba, and Aliyu Yakubu. For statement, di club thank dem for dia professionalism, commitment and contribution while dem dey play for Kano Pillars. Di club wish dem well for dia […]

todayJune 16, 2026 14

Sports

Edo Queens Lift NWFL Title After Dem Hold Bayelsa Queens

Edo Queens don win Nigeria Women Football League (NWFL) 2025/26 title after dem draw goalless with Bayelsa Queens for final Super Six match for Port Harcourt. Di result give dem enough point to carry di trophy as dem already dey on nine points before the game and just need one point to seal am. Na coach Moses Aduku team second league title in three years, showing say dem still strong […]

todayJune 15, 2026 16 15

Sports

South Africa Finish With 9 Men 

Mexico don show workings, start dia 2026 World Cup journey with 2–kondo win over South Africa for opening match wey hapun for Estadio Azteca. Na so south Africa players eavy for ground, nor fit carry body for di game, na so Mexico take advantage, three red cards come out, make South Africa finish with nine players for field. Julian Quinones naim score di first goal for di tournament while Raul […]

todayJune 12, 2026 13

Sport Yarns

Ronaldo Make History Again As Portugal Release World Cup Squad

By: Esther Ayoola Portugal national football team don confirm dia squad for upcoming FIFA World Cup 2026, with Cristiano Ronaldo set to make record sixth appearance for di competition. Head coach Roberto Martinez tuk say di selection carry emotional weight, especially as dem also honour former international Diogo Jota. Di 41-year-old striker being part of di squad mean say, im na one of di first 3 male player ever to […]

todayMay 20, 2026 17

Sports

Bassey Dey Ready For Liverpool Clash

Fulham don get better boost before dia Premier League trip go Liverpool, as dem don confirm say Calvin Bassey don recover and e fit play. Di Nigeria international bin dey doubtful after e comot from Super Eagles squad for March international friendlies because of back problem, wey make am miss matches against Iran and Jordan for Antalya. Im absence bin raise concern whether e go fit play Fulham important match […]

todayApril 11, 2026 16

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds