Labour Party Crisis

4 Results / Page 1 of 1

Background

National

Abure Point Finger To Obi, Otti Say Na Dem Scata Labour Party

By: Esther Ayoola Former Labour Party Chairman Julius Abure don accuse Peter Obi and Abia State Governor Alex Otti of causing di leadership crisis wey dey shake di party. Abure, wey tuk for TV sit down tuk on Tuesday, say Labour Party dey peaceful until Obi and Otti carry dia problem come, create caretaker committee for Umuahia. According to am, na dat decision scata di party stability and start di […]

todayJune 10, 2026 6

obodo oyinbo

Wahala for UK Labour Party as Health Secretary Resign put  more  Pressure on PM Starmer  

By : Jolayemi Olajide Fresh political pressure don land for UK Prime Minister Keir Starmer after di Health Secretary resign from office. Di resignation happen amid growing tension inside di Labour Party, as party members dey question leadership decisions and government handling of key issues. Reports say di move don increase pressure on Starmer to quickly stabilize im cabinet and rebuild confidence within di party. Political observers for UK say […]

todayMay 15, 2026 9

National

Labour Party Finally Agree Say Obi Leaving Wunjure Dia Party

By: Esther Ayoola Labour Party finally don admit say di leaving of dia 2023 presidential candidate Peter Obi to oda party really create big space for inside di party. Labour Party National Publicity Secretary, Ken Asogwa, naim dey yarn dis one on Monday during one media sitdon tuk while reacting to Obi alliance with ADC-led coalition ahead of 2027 election. Asogwa say Obi na major force inside the party and […]

todayMay 11, 2026 10

National

Court Sack Abure, Order INEC To Recognize Nenadi Usman

By: Esther Ayoola Federal High Court don go settle labour party leadership wahala, for Abuja on Wednesday,  dem rule say, Julius Abure, no longer bi  di  national chairmo of Labour Party say im tenure don expire. Na Human rights lawyer, Inibehe Effiong, na im yarn di mata for X, say im dey court when di judgment come out and say di decision follow earlier Supreme Court ruling. According to report, […]

todayJanuary 21, 2026 14

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds