National

Labour Party Finally Agree Say Obi Leaving Wunjure Dia Party

todayMay 11, 2026 1

Background
share close

By: Esther Ayoola

Labour Party finally don admit say di leaving of dia 2023 presidential candidate Peter Obi to oda party really create big space for inside di party.

Labour Party National Publicity Secretary, Ken Asogwa, naim dey yarn dis one on Monday during one media sitdon tuk while reacting to Obi alliance with ADC-led coalition ahead of 2027 election.

Asogwa say Obi na major force inside the party and im exit leave serious gap behind.

He sti open tuk say di party already expect Obi movement before e officially hapun on December 31, so dem don begin plan on how to reduce di effect on di party.

Written by: News Editor 2

Rate it

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds