LAGOS POLICE

6 Results / Page 1 of 1

Background

Lagos

Police Nab Lagos Couple Wey Fake Kidnap

By: Esther Ayoola Di Lagos state police command don go arrest one couple wey call demselves Fred and Goodness afta dem stage dia own kidnap to collect N10 million ransom from family and friends. According to Police source, say dem fake di kidnap for January 7 because di man wan travel  back to US and  as money no dey, so dem make di plan together. Say, na for one school […]

todayJanuary 30, 2026 3

Lagos

Lagos Police Blow Hot, Clear School Bombing Tori

By: Esther Ayoola Lagos State Police Commissioner, CP Olohundare Jimoh through di command tuk, tuk, SP Abimbola Adebisi don sama beta warning to all Aproko pipo for Lagos to  stop di  spread fake news. Dis warning follow news comot, afta aproko pipo begin spread rumor say, jaguda boys dey plan bomb two private schools for Ikeja. Adebisi explain, say Di Human Resources Manager and Chief Security Officer of di schools […]

todayJanuary 23, 2026 4 1

Lagos

Lagos Police Deploy 5,000 Officers, Say Make Dem Tackle Jaguda Boys

By: Rilwan Agbomeji As Lagos dey prepare for chrismas and new year di State Police Comand say dem dey tighten security across di state including di water ways. Say like dis dem don deploy 5000 security officers to make sure say residents and di state dey safe. Na for inside strategic management meeting wey dem do, Police Commissioner,  Moshood Jimoh share di updates say dem don ready dia rake, an […]

todayDecember 24, 2025 7

Lagos

Estate Agent Murder: Runaway Suspect Nabbed While Him Dey Find Passport for Lagos

Bayelsa State Police Command don catch the main suspect wey dem dey find for the kidnap and killing of one 42-year-old estate agent, Richard Ekpebu, wey dem find him dead body for bush on July 24, 2025. The suspect, George Idumangi, wey come from Ogbia Local Government Area of Bayelsa State, dey arrested on Monday for Lagos Immigration Office, as e dey try collect international passport to japa. Commissioner of […]

todaySeptember 23, 2025 45

Local

SP Adebisi Don Become New Lagos Police Spokesperson

The Lagos State Police Command don appoint Superintendent of Police (SP) Abimbola Adebisi as the new Police Public Relations Officer (PPRO) for the state. She dey take over from Acting PPRO Babaseyi Oluseyi, wey hold the position after Benjamin Hundeyin bin get appointment as Force Public Relations Officer (FPRO) on September 4, 2025. SP Adebisi get BA (Ed) in English Language and Literature from Tai Solarin University of Education, Ogun […]

todaySeptember 15, 2025 23

Lagos

Police Don Recover Stolen Bus, Nab Four People – One Vandal Dey Custody For Ojota

Operatives wey dey work with Lagos State Police Command, Tactical Team for Isheri don arrest four people wey dem suspect say be car thief, and one of dem na 31-year-old Salisu Ibrahim Abdullahi, during raid wey dem do for their hideout. Police still recover one Toyota Hiace bus wey dem thief during the operation. According to wetin the Command talk, the arrest na because of one report wey dem receive […]

todaySeptember 1, 2025 23

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app