Lagos Gorment Approve 13% BRT Fare Increase From March 2
By: Esther Ayoola Lagos State gornment don approve BRT bus fare increase by 13% say na Bus Reform Initiative schemes. LAMATA Head of Corporate Communication, Kolawole Ojelabi ni put dis for statement give tori pipo, say Govo Babajide Sanwo-Olu gree for di increase because bus operators dey complain money nor reach dem do anything. Ojelabi say, di new fares go start from Monday, March 2nd, 2026.