By: Esther Ayoola
Lagos State gornment don approve BRT bus fare increase by 13% say na Bus Reform Initiative schemes.
LAMATA Head of Corporate Communication, Kolawole Ojelabi ni put dis for statement give tori pipo, say Govo Babajide Sanwo-Olu gree for di increase because bus operators dey complain money nor reach dem do anything.
Ojelabi say, di new fares go start from Monday, March 2nd, 2026.