Lagos road crash

5 Results / Page 1 of 1

Background

Lagos

LASEMA Warn Drivers Afta Two Pipo Kpai For Trucks Askident

By: Esther Ayoola Lagos State Emergency Management Agency (LASEMA) like dis now, dey vex oh, dey, warn drivers to stop wawawa driving asap, afta two pipo kpai for askident wey hapun Thursday morning for Cele Bus Stop, Apapa-Oshodi Expressway. Untop yarnings with tori pipo, LASEMA Permanent Secretary, Dr Olufemi Oke-Osanyintolu, say, di  two 40-foot container trucks wey nor get  plate number,  collide, jam di other one wey park on im […]

todayFebruary 20, 2026 3

Lagos

FRSC Share Report Card Say 91 Kpai For Lagos Road Crash

By: Esther Ayoola Federal Road Safety Corps, Lagos state branch, don mark present, share report card say, not to make anibodi fear, say from dia record say wawawa driving don kpai at least 91 people across di state between January and November 2025. Lagos FRSC Sector Commander, Kehinde Hamzat, yarn dis one for tuk tuk meeting wey im do with tori pipo wey dem hold for Ojodu-Berger on Friday. Di […]

todayDecember 15, 2025 13

Lagos

Accident Scatter Lagos Ogun Road

By: Esther Ayoola Better  two days never pass wey  two people kpie for Ososa, Ogun State, another badness don sup again for  early  mor mor on Monday, say  one truck driver and him passenger kpai instantly after their truck jam trailer from back. Lagos State Traffic Management Authority (LASMA) spokesperson Adebayo Taofiq confirm say di crash happen for midnight when di truck run enter di trailer wey dey front. Same […]

todayDecember 9, 2025 8

Lagos

One Person Don Die, Six Others Don Injure As Lagos Bus Jam Tipper

One person don die, six others don injure as road crash jam Majidun, near Ogolonto, Lagos, after one commercial bus jam stationary tipper truck. LASTMA talk say preliminary investigation show say di Volkswagen commercial bus wey get number plate EPE 494 XM suddenly brake fail as e dey drive fast. Di driver lose control, jam di tipper truck wey dey roadside to buy diesel. Impact kill adult female passenger immediately, […]

todayNovember 17, 2025 7

Lagos

Truck Kill 3 University Students For Lagos, Injure Plenty People

Tension don burst for Ikorodu, Lagos as sand-laden truck lose control because brake fail, kill three students from Lagos State University of Science and Technology (LASUSTECH) and injure seven others. LASTMA confirm say di accident happen around Powerline Junction, inward Ikorodu Roundabout. Di truck reportedly dey move fast, ram plenty vehicles and tricycles before e finally scatter road. LASTMA spokesperson, Adebayo Taofiq, talk say di three students wey die, na […]

todayNovember 10, 2025 7

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app