By: Esther Ayoola
Lagos State Emergency Management Agency (LASEMA) like dis now, dey vex oh, dey, warn drivers to stop wawawa driving asap, afta two pipo kpai for askident wey hapun Thursday morning for Cele Bus Stop, Apapa-Oshodi Expressway.
Untop yarnings with tori pipo, LASEMA Permanent Secretary, Dr Olufemi Oke-Osanyintolu, say, di  two 40-foot container trucks wey nor get plate number,  collide, jam di other one wey park on im own.
Oga Olufemi say, na beg im take dey beg driver, make dem take am easy as life nor get duplicate.