NIGERIA POLICE FORCE

10 Results / Page 1 of 2

Background

National

President Tinubu Sack Igp Egbetokun, Tunji Disu Go Take Over

By: Esther Ayoola President Bola Tinubu don remove Kayode Egbetokun as Inspector General of Police. Human rights activist Omoyele Sowore ni dey share di update as im dey come out from court on  Tuesday for Abuja. According to Sowore, Tunji Disu, wey be Assistant Inspector General in charge of Force Criminal Investigation Department, FCID Annex for Alagbon, Lagos, ni  go take over di position. As at di time wey konfam […]

todayFebruary 24, 2026 11

Lagos

LSSTF, Police Airwing Start Sky Patrol To Tackle Crime For Lagos

By: Esther Ayoola Lagos State Security Trust Fund don begin touchlight area from air with ogbonge collabo with Nigeria Police Force Airwing Command to fight crime. For statement wey dem release on Monday to tori pipo, LSSTF Executive Secretary, Ayo Ogunsan, explain how dem wan take buy waka with di police. Ogunsan say dem go use helicopter patrol to gada security informate, and  respond fast to threats, say criminals nor […]

todayFebruary 24, 2026 5

National

Kaduna Police Go Hard On Bandits, Gbab Suspected Drug Suppliers

By: Esther Ayoola Kaduna State Police Commissioner, Rabiu Muhammad, don share report card say dem do commando neutralise plenty suspected bandits for Kajuru, Tafa, Igabi, and Kauru Local Government Areas during dia February 2026 operation. Im dey yarn dis one for force headquarters, say na based on  intelligence-doings, dem take locate di  bandits’ camps and criminal hideouts. Mohammed say nor be small gun battle dem do with di jaguda boys, […]

todayFebruary 24, 2026 3

National

El-Rufai Drag ICPC, I-G & AGF Go Court Over Abuja House Raid

By: Esther Ayoola Former Kaduna State Governor, Nasir El-Rufai, don drag Independent Corrupt Practices Commission, ICPC, go court for ₦1 billion, say dem enter him Abuja house without permission. Im lawyer, Oluwole Iyamu, SAN, clear tori pipo for Abuja say di search warrant wey Chief Magistrate for FCT issue on February 4 nor follow at all. For di suit wey dem file on February 20, El-Rufai name ICPC, di Magistrate, […]

todayFebruary 24, 2026 3

National

Ogun Police Cut Chain For Tiktoker Say She Deceive Members Of Di Public

By: Esther Ayoola Ogun State Police command don plan to arrest one female TikTok user wey dem sabi as Mirabel afta investigation proof she lie say person rape her. Nor be amebo say, Mirabel tuk for one viral phone chat with social media influencer, VeryDarkMan (VDM) of how one man rape her. Say na only she implicate herself, tell VDM for audio call say, di claim na lie, For di […]

todayFebruary 20, 2026 2

National

Osun Police Command Gbag Travel Agent Say E Scam N3.6M

By: Esther Ayoola Police for Osun State don arrest one travel agent wey dem dey accuse say im scam two pipo of N3.6 million. Say di money na for visa and flight tickets to Luxembourg. Tuk, tuk of di osun police command, DSP Abiodun Ojelabi, explain, say di victims meet di suspect through one friend for January 2025. Dem give am di money make e arrange di visas, but instead, […]

todayFebruary 13, 2026 1

National

IGP Explain How Naija Police Go Take Sharpen Dia Skills For Peace-Keeping

By: Esther Ayoola Oga Inspector General of Police Kayode Egbetokun say Naija Police go need focus more on specialised skills for peace-keeping work, dat, na wetin dem go dey do moving foward. IGP explain say, nowadays, di work dey hard police to do peace keeping because of terrorist threats, violent extremism, organised crime and digital wahala. Egbetokun drop dis yarnings yesterday for one two-day lecture wey Naija Police do with […]

todayFebruary 3, 2026 6

National

Police Confamate Release of Six Vigilantes Wey Army Arrest For Edo

By: Esther Ayoola Kwara State Police Command show workings confamate say dem don receive and later release six vigilante members wey Nigerian Army arrest earlier for Edo State. Police tuk say soldiers stop di vigilantes for Auchi–Ikpeshi Road for Akoko-Edo LGA for early December 2025 as dem dey travel inside motor wey belong to Ifelodun Local Government for Kwara State. According to police statement wey come out on Tuesday 6th […]

todayJanuary 7, 2026 6

National

IGP Egbetokun Move DIG Gumel, 17 CPs Go Key Police Posts

By: Rilwan Agbomeji Inspector-General of Police, Olukayode Egbetokun, don deploy Deputy Inspector-General of Police Mohammed Usaini Gumel and 17 Commissioners of Police, suk dem for various departments, commands, and formations for inside di obodo Nigeria. According to di Force tuk, tuk, Benjamin Hundeyin, di deployment na to make police work stronger, improve leadership, protect people well, and give beta service. Under di new arrangement, DIG Gumel go head di Force […]

todayJanuary 6, 2026 8 4

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app