NIGERIA POLICE FORCE

34 Results / Page 3 of 4

Background

National

IGP Olatunji Disu Make Move To Reduce Police Tactical Teams

By: Esther Ayoola Police oga for Naija, Olatunji Disu, on Sunday for Abuja don order make dem reduce tactical teams across di country. According to police tuk tuk, Anthony Placid, say di IGP say zonal and state commands no go get pass five teams, while area commands and divisions go get only three teams. Im explain say dis decision come based on di plenty tactical units wahala and dat some […]

todayMarch 23, 2026 26

National

Ondo Police Gbab Jaguda Rape Suspect

By: Esther Ayoola Ondo State Police Command dem waka one ogbonge waka arrest one 21-year-old man, Alabi Anthony, for allegedly raping and kpaing a woman, Olaseni Veronica, for Iboropa community, Akoko North-East Local Government Area. Command’s tuk, tuk, DSP Abayomi Jimoh, say di suspect dem go catch am following intelligence, and dat na di victim wey dem track her missing phone na dem take succeed gbab di suspect. Oga Jimoh […]

todayMarch 23, 2026 16

Lagos

Lagos CP Olohundare Promise To Remove Taskforce Wey Abuse Go Office

By: Esther Ayoola Lagos State Police Commissioner, Olohundare Jimoh, don tuk now say, e no go hesitate to dissolve any task force wey personnel dey violate human rights. Jimoh tuk dis one on Saturday as e dey brief journalists for Ikeja headquarters. Dis come afta one video wey dey online show how traffic officer abuse traffic offender. But di police oga say nothing show say dem abuse or shame di […]

todayMarch 23, 2026 27

National

Police Commission Promote 13 CPs Go AIG Rank

By: Esther Ayoola Police Service Commission don approve promotion for 13 Commissioners of Police (CPs) go higher rank of Assistant Inspectors-General of Police (AIGs) afta dem pass written exam and interview for Abuja. Names of di promoted officers include Emmanuel Ado Christopher, Joseph Eribo, Dantawaye Miller, Uche Ifeanyi Henry and Olarenwaju Peter Ogunlowo among odas. For di same exercise, 17 Deputy Commissioners of Police (DCPs) sef don rise go Commissioners […]

todayMarch 13, 2026 28

National

IGP Disu Appoint DCP Anthony Placid As New Police Tuk, Tuk Person

By: Esther Ayoola Di Naija Police Force don appoint DCP Anthony Okon Placid as new Force tuk, tuk person Say na di outgoing tuk, tuk, Benjamin Hundeyin, ni use im own mouth tuk am, on Sunday to tori pipo. From report, Placid go replace Hundeyin wey don dey di job since 2015, Say dis one dey follow afta IGP Olatunji Rilwan Disu reshuffled police top officers. Placid, wey im mama […]

todayMarch 9, 2026 25

Lagos

IGP Disu Give Order To Police To Stop Over Sabi Work

By: Esther Ayoola Inspector-General of Police, Tunji Disu don order make dem reduce di number of police tactical teams wey dey operate across Naija. Lagos State Police Commissioner, Olohundare Jimoh na im relate dis mata for Abuja when police commissioners gather for meeting with di Inspector-General of Police Tunji Disu. Say, di order na part of di reforms wey di Naija Police Force dey do to improve professionalism, accountability and […]

todayMarch 9, 2026 25

National

President Tinubu Sack Igp Egbetokun, Tunji Disu Go Take Over

By: Esther Ayoola President Bola Tinubu don remove Kayode Egbetokun as Inspector General of Police. Human rights activist Omoyele Sowore ni dey share di update as im dey come out from court on  Tuesday for Abuja. According to Sowore, Tunji Disu, wey be Assistant Inspector General in charge of Force Criminal Investigation Department, FCID Annex for Alagbon, Lagos, ni  go take over di position. As at di time wey konfam […]

todayFebruary 24, 2026 37

Lagos

LSSTF, Police Airwing Start Sky Patrol To Tackle Crime For Lagos

By: Esther Ayoola Lagos State Security Trust Fund don begin touchlight area from air with ogbonge collabo with Nigeria Police Force Airwing Command to fight crime. For statement wey dem release on Monday to tori pipo, LSSTF Executive Secretary, Ayo Ogunsan, explain how dem wan take buy waka with di police. Ogunsan say dem go use helicopter patrol to gada security informate, and  respond fast to threats, say criminals nor […]

todayFebruary 24, 2026 39

National

Kaduna Police Go Hard On Bandits, Gbab Suspected Drug Suppliers

By: Esther Ayoola Kaduna State Police Commissioner, Rabiu Muhammad, don share report card say dem do commando neutralise plenty suspected bandits for Kajuru, Tafa, Igabi, and Kauru Local Government Areas during dia February 2026 operation. Im dey yarn dis one for force headquarters, say na based on  intelligence-doings, dem take locate di  bandits’ camps and criminal hideouts. Mohammed say nor be small gun battle dem do with di jaguda boys, […]

todayFebruary 24, 2026 31

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds