Osun APC Blast Adeleke, Say Him Dey Find Excuse Before Election
By: Esther Daniel Osun State APC don fire back at Gofnor Ademola Adeleke, say all di allegation wey him make against Presido Bola Tinubu and Minister of Marine and Blue Economy, Adegboyega Oyetola, na empty talk and excuse before August 15 governorship election. For statement wey party Media Director Kola Olabisi release on Tuesday, APC tok say Adeleke claim say Tinubu and Oyetola dey persecute am politically no get head […]