By: Esther Daniel
Osun State APC don fire back at Gofnor Ademola Adeleke, say all di allegation wey him make against Presido Bola Tinubu and Minister of Marine and Blue Economy, Adegboyega Oyetola, na empty talk and excuse before August 15 governorship election.
For statement wey party Media Director Kola Olabisi release on Tuesday, APC tok say Adeleke claim say Tinubu and Oyetola dey persecute am politically no get head or tail. Di party dey react to wetin di Gofnor yarn during campaign rally for Osogbo on Monday, where him accuse di Presido, Oyetola and security agencies of playing politics.
APC come accuse Adeleke of leaving di real problems for Osun and choosing to dey throw blame instead. Di party even allege say Government House don turn safe hideout for political thugs and question why some convicted offenders recently collect amnesty.